Powered By Blogger

Sunday 7 June 2015

» Here Are Some Silly Questions People Ask In Obvious Situations «

1. You see identical twins, you still dey ask 'na
twins be dis'? No bros, na picmix...lol .
2. Nepa brings light and everyone in the
neighborhood shouts 'up Nepaaa'! My guy ask
me, O boy na light be that? No oh, Na Holy Ghost
fire! Lol! .
3. You see person dey vomit, you still dey ask
am 'you no well'? Em well, e juz dey practice
how to vomit. .
4. You just wake up from sleep person come ask
you "you don wake?" No oh, I come buy bread
wey I go chop for dream. .
5. You see woman wey born new pikin u ask her
"madam u don born? " No ohhhh, she buy am
for OLX... .
6. You greet person "good morning ma" ! She
ask, my pikin you don wake ? no ohhhh, I dey
sleep walk... .
7. My guy ask me "O boy where u dey?" I tell am
say i dey bank, nd him ask me "Wat is happening
there?" Nah new yam festival.. *LMAO* .
8. My neighbour sees me opening the gates to
drive out and asks me, U dey comot? Not at all...
I be the new gateman... .
9. I dey watch film… my guy enta come ask me
"Guy na film u dey watch? No naa... I dey discuss
with Osuofia... .
10.U see me dey chop indomie come dey ask
me, O boy, na indomie u dey chop so? No
ohhhh... Na fried rubber band mixed with thread.

No comments:

Post a Comment